September 21, 2024
11 September 2022New Informate 18 September 2022Di Queen coffin dey lie in state for Westminster Hal.......

11 September 2022

New Informate 18 September 2022

Di Queen coffin dey lie in state for Westminster Hall for di third day, ahead of her state burial on Monday 19 September.

Di hall dey open 24-hours-a-day until Monday morning for members of di public to file past di coffin and pay dia respects.

Long queues don form for central London. Pipo wey wish to pay dia respects virtually fit watch a dedicated BBC live stream.

Dis na your guide to wetin go happun, day by day.

Today na di third full day wey di Queen coffin go lie in state for Westminster Hall, wia she go remain until di morning of di funeral.

Hundreds of thousands of mourners dey expected to pay dia respects for di 11th-Century building, di oldest part of di Palace of Westminster.

Long queue dey wey dey pass di South Bank, pass di National Theatre, di Tate Modern and HMS Belfast, through to Southwark Park.

Di UK goment don publish one live queue tracker for pipo to follow on YouTube. And if pesin get questions about wetin to bring and wetin you no fit carry enta, read our guide to attending di lying in state.

Members of di public dey able to walk past di Queen closed coffin, wey rest ontop one platform wey dey raised platform, wey dem dey call catafalque.

Later today, di Queen grandchildren, including di Prince of Wales and di Duke of Sussex, go observe one 15-minute vigil inside Westminster Hall.

As King Charles request, both Princes William and Harry go wear military uniform for di occasion.

Di brodas go dey joined by Peter Phillips, Zara Tindall, Princesses Beatrice and Eugenie, Lady Louise Windsor, and James, Viscount Severn.

Di Prince of Wales go stand for di head of di Queen coffin, while di Duke of Sussex go stand for di foot side.

Di Queen coffin go lie in state for di fourth full day for Westminster Hall.

Dem go hold one-minute silence across di UK around 20:00. Pipo fit mark di silence privately for dia own homes, on di street with neighbours or for community events and vigils.

Di Queen state funeral go take place on dis day for Westminster Abbey at 11:00 in di morning.

Dem go invite Heads of state from across di world to join members of di Royal Family to remember di life and service of di Queen.

Senior UK politicians and former prime ministers plus representatives from di charities she bin dey support dey expected to attend.

Afterwards, di funeral procession go proceed to Windsor Castle, di state procession go den take di coffin along di Long Walk to St George Chapel for Windsor Chapel, wia a committal service go take place.

Di date go be national bank holiday, wit some services and businesses wey go dey expected to close.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *